Sunday, 16 June 2013

Psalm 23 In Pidgin

PSALM 23 IN PIDGIN ENGLISH

1. The Lord na mai Shepherd, I deykampKe

2. He make me sidon for where betta dey flow and come put me next to
stream make mai bodi Thermacool.

3. He panel beat my soul come spray am white, come dey lead me dey go
through express road of righteousness for sake of Hin Name.

4. Walahi! If I waka pass where arm robber, 419, and juju people
borku, come even join okada reach valley of the shadow of death sef,
mai bodi dey inside cloth. Your rodand staff nko? Na so them dey like
back bone dey comfort me.

5.You don prepare Banga and starch make I chop. All my enemiesdey look
anyaya. You rob me for head wit Vaseline Intensive Lotion.My cup na
Ogunpa River wey comeoverflow hin bank.

6. True, true, betta life & mercy go gum my back till I quench. And
man go tanda for God house sotey sotey from Lai lai to lai lai. GOD

ALMIGHTY, NA YOU BIKO. AMIN!!

No comments:

Post a Comment